The Economic and Financial Crime Commission (EFCC) has vowed to do its best to locate, investigate and arrest anyone causing economic unrest.

This came in days after citizens were seen taking to the streets to protest against the activities and methods.

Here is what the commission had to say about the protest on their official Instagram page;

“But wait o, before we begin
This matter no clear
Because, If your hands clean
So why you dey fear?
This Commission dey fight
For our children unborn
Make dem for get better country
When we’re long gone.
Politicians no dey try
See, everybody knows Their own na to dey lie
Busy dey steal our dough
See how my mama just dey cry
The hunger don reach her throat
God, abeg make she no die
Even if na small chau for the bowl.
Okay, i dey see yahoo boiz I be like, wetin dey sup ?
For my area na so-so noise
Anytime the bah drop
How you go thief person money
Dey chop
Go club, flex every
Still dey happy ontop?
Naija na our country
Na only am we get o
If we use corruption finish am
Where we go go when e set o?
Make we put heads together
Join hands, even legs o To kick corruption out
This option na de best o.”

Leave a Reply